Social Icons

Pages

Sunday 26 May 2013

TALK ABOUT IT: A LETTER TO TONTO DIKE


 Here's an exclusive article off the forthcoming June 12 edition of ten10 magazine 
try not to laugh too loud o! *wnx*




On the faithful 17th day of October 2012 nollywood actress "tonto 'charity' dike" also known as "tonto dike"shocked nigerians and the music industry with her debut 'GBEDU' "HI" and like every artiste while recording, she hoped and wished she just recorded a "hit banger!".
Well let me say she not only succeeded in recording a "laugh banger" she also succeded in alerting some concerned Nigerian's attention...
...Here's what ONOME PHILIP from delta state university (DELSU) had to say
(this letter was recieved via email from onome himself)
 




Dear  tonto
                       First of all, i wan make you understand say na my church mind i dey yarn o.
I know say as 2face carry talk am (no be everybody sabi play ball) but wetin dey vex me na wen pesin wey know say em no sabi play ball com go wear jersey buy boot on top.
when i bin hear say you drop one song like dat wey dey make people laugh, the first thing wey i say make i ask u NA... "WHO SEND  YOU?!"
abi you bin forget say na film you dey act? abi film don finish to act? abi mercy johnson don finally block market for you?, why you go dey commit dat kin public wahala na?.
Nothing com shock me pass wen i com go download the song for wadupnaija.com,
as in enh...laugh no gree me vex again, e com confuse me wether na a.y abi basketmouth write the song den maybe gordons com nack the beat! chaaai!... i com begin dey ask myself again "WHO SEND YOU?!" but wait o...
...which one com be "POKO BABY" again? abi na your new name be dat?.
                      Well, i no know wetin you bn dey think o, abi na pesin give dat kin wicked advice say music go fit you, make i just tell you..."IF YOU NO SABI PLAY BALL, NO GO WASTE MONEY BUY BOOT NA" dem no dey beg shit to smell , dem no dey force rain make e fall, na film wey u sabi act na? allow people wey sabi sing make dem sing , if you no know wetin to carry money do, go find upcoming artiste wey sabi sing,give am money make em blow well , after all e no go bad if  you become boss like banky and donjazzy still dey act your movie.
                      No wahala sha...carry on...
...e better make u dey do your yeye gbedu so if bad thing happen, man pikin fit use am dey kill belle with laugh. but na for only you o.
make i no go wake up one morning hear say segun arinze abi kanayo o kanayo don drop song shoot video on top. lwkmd! as segun eyes dey sef em fit drop song call am "LOOK" lol. since your own na "HI" lol.
And that was all onome had to say...lol
FOR MORE INTERESTING ARTICLES, NEWS AND OTHER FUN PAGES, WAIT TILL JUNE 12th...TEN10MAGAZINE IS COMING!!!



No comments:

Post a Comment